Justice For Ìyá ọlọ́jọ̀jọ̀
Ta ló ń fí ìyá ọlọ́jọ̀jọ̀ ṣeré🎼🎼🎷🎹
Ìyá ọlọ́jọ̀jọ̀🎼🎼🎷🎹
Ó n tá ṣánṣán sími nímú🎼🎼🎷🎹
Ìyá ọlọ́jọ̀jọ̀🎼🎼🎷🎹
Ó n tá dòdò sí mi lọ́fun🎼🎼🎷🎹
Ìyá ọlọ́jọ̀jọ̀🎼🎼🎷🎹
Dokinta Ọlọ́jọ̀jọ̀ of the abroad
Ọ̀gbẹ́ni Lactogen of Lasgidi
Abegi abegi which wan be Ọ̀gbẹ́ni
Na Yoruba version of mister nau
I take Baba God beg you o
Beht you and Baba Kabiru grow for Alimosho
Nor dey lie for mai head o
Late Ọ̀gbẹ́ni Akeredolu was a good man though
I say I no wan ansa Ọ̀gbẹ́ni, abi na force
Okay nor vex o mai guy
Wetin be ọ́jọ̀jọ̀ sef
Na water yam dem dey use make am
Dat wan nor be ìkọ́kọrẹ́
Na Ijebu feofle dey use am for ìkọ́kọrẹ́
Okay wetin come hapin for the song
You nor hia wetin dey xup
On top akara, corn and kulikuli mata
Yes nau
Hao e take consine ọ́jọ̀jọ̀
Dem suppose include am nau
Wait make I think wella
You dey dream for afternoon
So for Ekiti una nor get akara
Hao we nor go get akara
Why you dey hala for ọ́jọ̀jọ̀ then
Ọ́jọ̀jọ̀ suppose dey the grant nau
Beht etc, etc dey hinsaid nau
We nor wan dat wan
Me I nor come understandable you today
Na so dem do us before o
Wetin dem do you
Railway nor rich awa side nau
Chai, you be yeye persin
Why you dey swear for me nau
Because of railway na im you dey sing ọ́jọ̀jọ̀
Persin wey see Sango enta ground
Suppose dey kaiful next time
Dat wan na true yarn
After all, what is good for the goose
Should also be good for the gander
Everywhere and everything should be covered
To make the grant a balanced one.
So you get akara and ọ́jọ̀jọ̀ for Ekiti
Àbàrí dey, ògbókùrù dey too
Village Boy Plenipotentiary
Na tiri man you dey call so
Yeyenatu tie wrapper for you
Which kin opkata meow you yarn so
Abegi shift for wan kona
Wetin you want true true
Make IAGF add ọ́jọ̀jọ̀ to the list
Àbàrí nko, ògbókùrù nko
All join togeda
Wait fess o
Wetin do you o
Wetin be IAGF
Iya Alakara General of the Federation.
Aswear down, you nor well at all at all
Make I go take my Jogbójogbò sharpale
Ya mata don taya me
Mai fren by faya by force
If we are going to do it
Let it be inclusive
With nothing in the bracket
Left undone at all
Otherwise it becomes injustice
To the local delicacies
That also need economic empowerment
Even if they are so micro in nature.
When can I have a taste of ọ́jọ̀jọ̀
Nor be Akoko dem born ya papa
Beht I be Lasgidi guy nau
Go an visit ya papa village
And enjoy the aromatic ọ́jọ̀jọ̀
Wash down with fresh ògùrọ̀
©TheVillageBoy.
(The figure man who loves alphabets)

