๐๐ฆ๐๐ฅ๐-๐๐ข๐๐๐ ๐๐ ๐๐ฎ๐ง๐ข๐ ๐ฐ๐
You be glutton ๐ผ๐ผ๐ท๐น
I nor be glutton๐ผ๐ผ๐ท๐น
You be longer throat ๐ผ๐ผ๐ท๐น
I nor be longer throat๐ผ๐ผ๐ท๐น
You laik chop chop๐ผ๐ผ๐ท๐น
Who nor laik chop chop๐ผ๐ผ๐ท๐น
Chief of Staff Supreme Royal Amala Republik
Yeyenatu runaway Dokinta of the abroad
Wetin I do you nau
Wetin you nor do me
If you Tarka me I go Darbo you fah
If you Darbo me, mesef go Tarka you
Na so somtin don become
Do me I do you Baba God nor go vex
Hao you take know dat wan
Laif nor pass laikdat o
You nor know wetin amala dey cause
You mean Amala deede politrick
I know say you go sabi am
Na persin wey nor chop dey hola o
Dat Abatiโs theory nor work again o
Hao e not take work again
You nefa hia wetin dey xup
For wia, bikonu yarn me koret
You nor hia ovationally compliant
And im Ambasido kanterpat
On top advice for awa Presido
I hia say dem throwey Ogbinigwe up an down
Nor be smo somtin fah
No name wey dem nor call demsef o
One because dey nor invitation am
To come chop regular Amala laik before
Beht the wan wey dey chop suppose behave nau
As per say table manner must be observate
Eggxactly my dear broda
God nefa show you ya broda
Na so dem dey throwey punch hia and dia
On top ordinary okpata meow fah
Dose guys wan show say Amala still dey sweet
And as Hunkle mouth nor rish am
Maybe n aim make he dey yarn
Advice wey dem nor ask am
But those guys broke the rules
Based on Abatiโs theory of Table Manners
Therefore, they should be immediately
Wisk away from the table.
Dat wan nor too harsh so
Hao e take harsh for ya eyes
Dem dey defend dia Amala portion nau
Okay, dem nefa serve dem finish sef.
Na why dem suppose dey quiet nau
When dogs bark na to show say dem dey nau
Dat is anoda somtin o
Trust ya paddy nau
Nor be im make I hail you as Chief of Staff
Henniwey I go manage am laikdat
As per say we be paddy tey tey
No leave no transfer
Wetin make Bobo Dee do nau
Make im go appease the Garrison Commander
Of Amala Deede Royal Republik
Say smo pikin nor dey sabi wak agidi
Make e nor spoil im hand
Make dem find am somtin
To hol belle before e puncture finish
Ya neck still dey hold ya head.
Hao about the Ambasido guys
Make dem withdraw dem serfiticate joor
After dem don go gee testimony finish
And then?
Haba make dem just warn dem
And ask dem to sin no more.
D kin kasala Amala go cause
Stomach infrastructure nor go fit handle am
Beht persin wey hungry
If hin nor shout
Dem fit nor rememba am fah
Especially when the Amala still dey hot
As o gbona feli feli
After all, Amala is better served hot.
ยฉTheVillageBoy.
(The figure man who loves alphabets)

