Hunkle Zacchaus of Lasgidi, how far?
Wetin dey far runaway Dokinta
Nor be you be payroll akatant
After dat nko
You suppose update us nau
On top wetin o
Hao the kusa take land in January
Wetin consine you hinsaid
We wan know as tax deductions dey
I dey work for NRS?
Beht na you work una payroll
Make I send you dem payslips
Dat wan na illegal somtin o
Okay wetin you wan know
Kusa go up or down?
That actually depends on the pay bracket
Can we start with yours first
What do you want to know
What is the change in your net pay?
If you must know, I paid a little more
Dat is fantabulous
Please be serious for once.
Na so e be across the board
Most other staff have increases in net pay
So the tax nor dey oppressive
I just told you I paid more.
Well, na because you earn more
I nor laik dis headache you dey give me
You suppose yarn me ya paddy nau
Say wetin hapin
It is also great to have feedback
About any policy when implemented
Especially new or amended policies
That enables us to know if it is working.
Eeyah, sorry for ya smo loss
Wia I yarn you say e smo
Henniwey na vomit as you chop
Somtin dey do you aswear tu God.
At least, the noise has reduced
Which noise reduced
About the government making people pay more taxes
Well, some still pay more.
Na dose wey dey kolet fat kusa nau
Nor be only fat kusa, na big kusa
Olof dem na same same.
Beht wait o
For wetin again nau
Dem add benefits in kind
Which wan be dat again
Messenger wey helep you wash ya car nko
I suppose add dat wan to my emolument again
Nor be service rendered and enjoyed?
We suppose monetize am also
Yes, nau, abi wetin you think
Nor let dem hia you fah.
We hope we get more feedback
About the implementation of the new taxes
Then we can know what to do next
By speaking from a point of knowledge.
Okay, mai broda, see ya on anoda pay day
You nor go shake body smo
I nor get malaria o
Who dey yarn dat wan with you
Which body I wan shake then
Send me smo kusa nau
You wan kolet ya tax back from me
Na sense go still wonjoor you las las
I wish you the same
Comot hia, Efostik Aradite kawai.
(𝑻𝒉𝒆 𝒇𝒊𝒈𝒖𝒓𝒆 𝒎𝒂𝒏 𝒘𝒉𝒐 𝒍𝒐𝒗𝒆𝒔 𝒂𝒍𝒑𝒉𝒂𝒃𝒆𝒕𝒔)

