Ọ̀ga mi ṣojú mi wáí 🎼🎼🎷🎹
Ẹ̀rù rẹ é le bànìyàn 🎼🎼🎷🎹
Ọ̀ga mi pojú mi dà 🎼🎼🎷🎹
Ẹ̀rù rẹ é le bànìyàn 🎼🎼🎷🎹
Chief Femi Ariyo the Second
Nor be only Femi Ariyo na Elemure
Beht na im song be dis nau
I just use am for stage
Akiika wonderment nor go finish
We get awa own band nau
Wetin you call am again sef
Ekiti Native Blues Archipelago
Wetin we see hia today
Na waka waka politicians o
Wetin dem do dis taim arrand o
You dey close ya eyes waka
Abegi you wan gist or you no want
As my koret guy, no lele.
Shey nor be Articulate and Obidient you dey yarn
Dem push am from Pindinpin
Come land for Yaba Left
Haba which kin Yaba Left
Nor be Yaba Left Labour dey
Na Yaba Right Labour Congress dey nau
From wia nau
From Yaba going to Oyingbo
From Western Avenue to Lagos nko
Olof of Yaba go dey left
Wait fess, wetin you dey yarn
As dem come Yaba dem come dey do skosko nau
Beht Labour Party nor be the same nau
Pap water is pap o
Agbekoya and Action Group na the same
You say wetin?
Alright kontinuu
Afta dem separate finish o
Dem go do anoda kolabo for ADC
Na im Oga wan play am siki wan again
Beht e don kolet freedom since
Dem say make e do Journeyman nau
Hao dat wan take make sense
Once Oga na Oga for laif o
Who sai
Dey dia dey halla
Wetin come hapin nau
Dem waka comot sharply, sharply
Laik a rolling stone
Dat gada no moss
Dem suppose stay
Hao you take see am nau
Journeyman beta pass apprentice fah
If dem kash you for Ojuelegba
You don forget who I be
Bobo Lactogen of Lasgidi
The confirmed Odogwu of alayes
Twale for you with two hands up.
So for tiri yias
Dem waka for tiri parties
Nothing wey dey new
Dis wan dey new o
Dis taim na with Kano strong man o
Kano na local Rebels since
Wetin you mean
Dia influence nor pass Kano
Hao you take know dat wan
Highest dem do smo for Kaduna
From Aminu Kano taim fah
Ya neck still dey hold ya head.
What if ground nor level again
Na to waka comot again
And look for anoda grass wey green
To kontinuu the waka waka.
It is the movement of the people
With no stable address
And yet not building any structure
If that is not nomadic
Then what is it?
A long trek to Uhuru.
©TheVillageBoy.
(The figure man who loves alphabets)

