E Ba Wa Kigbe Ole O (The Mob Crowd)
Ẹ bá wa kígbe olè o🎼🎼🎷🎹
Olè, olè🎼🎼🎷🎹
Ẹ bá wa kígbe olè o🎼🎼🎷🎹
Olè, olè🎼🎼🎷🎹
May Sound Sultan’s soul rest in peace
Laik say e saw the future
Beht nor be today tief tief start nau
E get tief wey dey bring shame o
Yarn me wetin I nor understandable o
Wetin you mean by dat
Which tief tief nor dey bring shame
Olof dem suppose bring shame
I for surprise if e nor be so
Beht shame get level nau
Hao many levels shame get
Shame wey dey swallow shame dey
Ordinary shame dey
Then shame wey dey shame shame dey
Dis man wan burst my brain o
Na me be dis man
Abi you nor be man again
I be kwaret man o
Odogwu nor ritayament
Na man you dey hola so
Nao wetin be the koko of the yarn
So you nor hia wetin hapin for TikTok
Plenty dey hapin dia efiriday nau
You nor hia Bandits do laif show
I hia say dem do giveaways o
Abi you follow kolet
Wetin you take me resemble
Na kwesion I ask o.
For ya eyes I nor get shame
Shame fit don tie you wrapper nau
If I swear for you
Swear nor dey kash me.
Honestly, it is beyond imagination
That people will be dropping aza
To collect giveaways from Bandits
When we are bleeding as a nation.
What a caricature
Of a moral degenerate
Without restraint
Aiding and abetting evils.
As in tief kari and tief kolet
With no shaming shame at all
Ganusing of blood money
Of feofle wey don throwey conscience.
How low can we go
Of galivanting towards anything
That just smells money
It is both sad and pathetic.
Who come tief pass
Between Bandits and Collectors
Of bloody giveaways
Just because of hunger or poverty.
Tief na tief o
Bandits or giveaways collectors
Na the shame pikins of
Shameless malle and palle.
Shame on you all
Who collected the blood money
From marauding Bandits
All in the name of giveaways.
©TheVillageBoy.
(The figure man who loves alphabets)

